PIDGIN DI PURSUIT OF KNOWLEDGE!

Proverbs 18:15 “Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.,   

 

Everybody for dis life dey chase someting. Wetin you dey chase? For Bible, knowledge mean make person sabi, recognize or understand someting. Hosea talk say if person nor get knowledge, wahala fit jam am, but di wahala be say if person dey too pursue knowledge without God, e nor go better. Bible talk say di best knowledge wey we suppose get na di one wey concern God (Proverbs 2:5). But dis knowledge nor be just grammar or book knowledge—e mean say make we sabi God for our life proper proper (Philippians 3:10). Jeremiah 22:15-16 talk say make we dey live in way wey go show say we respect God power, nor be just to sabi book matter. 

To sabi say God dey nor reach at all. Di real knowledge of God na to get beta relationship wit am. Nowadays, many self-help books dey everywhere, dey tell us how to do plenty things. But Ecclesiastes 12:12 talk say some books nor good for us. E get many believers wey dey quote dem, dey follow dem like say na Bible, but dem nor go gree sabi di wisdom wey God don put for scripture. To read or write book nor bad, but make we remember say na God dey give di real wisdom wey go help person for life (Proverbs 2:6). 

Apostle Paul do plenty beta work for God. Even as dem flog am, put am for prison, snake bite am, shipwreck catch am, and wahala full im life, e still write half of di New Testament because God dey inspire am. Di knowledge wey Paul get na experience knowledge—Jesus show am di gospel, e make sense for am well well. Paul life show say no human fit sabi everything. 1 Corinthians 13:9 talk say na only di one wey we need for dat moment na God dey show us. Knowledge na journey, nor be one-day work. 

Make we dey pursue knowledge steady, but make na God own knowledge we dey find pass because e dey fresh everyday. Make we be like deer wey Psalm 42:1 talk about, wey dey thirsty for God own knowledge, wey dey give everything we need. Human knowledge wey nor get love inside na waste (1 Corinthians 13:2). God wisdom and power dey show for everything wey e create (Romans 1:19-20). E sabi all, e wise pass everybody, and e fit give us wetin we need for life. 

Why learning dey important? Proverbs 1:4 talk say knowledge go make mumu person wise, e go help young people find purpose. To sabi Jesus na di key to purpose for life. If you dey struggle wit purpose, make you sabi God word well—e go show you wetin you suppose do. Proverbs 2:10 talk say wisdom go enter your heart, and knowledge go bring you joy. If you use di wisdom wey God don give, e go help you avoid plenty bad choice. 

Knowledge nor be by mistake, person gats work for am. Even though our body fit dey naturally like some kind things, we gats make effort. But human knowledge dey make people proud (1 Corinthians 8:1). To dey find knowledge just for knowledge sake without God na foolishness. Di way we sabi God suppose be serious matter, nor be play-play. 

God don put something inside everybody, but na we gats act on am. Na di truth wey we sabi na e go make us free. Nor go perish because you nor sabi di right knowledge. Chase knowledge, but make e be God own knowledge. Knowledge na power—but knowledge of God na di one wey fit change life! 

PRAYER: O Lord, abeg direct our steps. Make our hustle for knowledge carry us go where You dey. Any knowledge wey nor go honor You, make we nor go near am. We wan sabi You well well, make Your light shine for everything we do. We pray all dis one for di mighty name of Jesus. Amen!

https://creators.spotify.com/pod/show/womenoflight/episodes/PIDGIN---THE-PURSUITE-OF-KNOWELDGE-e33h3q6

Follow the FRESH MANNA CHANNEL on Telegram: https://t.me/freshmdevo

Follow the FRESH MANNA CHANNEL on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029Va8y5tqAjPXP6kZdoX1j

EMAIL: TEEWOMENOFLIGHT@OUTLOOK.COM

WOULD YOU CONSIDER PARTNERING WITH US TO REACH MORE PEOPLE? BY SHARING THIS MESSAGE ON YOUR PLATFORMS AND CONTACTS OR  SOWING A SEED TO HELP US KEEP DOING THE WORK OF THE MINISTRY.

WE APPRECIATE YOUR GENEROUSITY AND SUPPORT.

SHALOM

Comments

Popular posts from this blog

IT IS NEVER TOO LATE TO START AGAIN!

DIVINE VISION!

RESISTANCE FROM STEPPING INTO PURPOSE!