PIDGIN IMAGINATION!
1 Kings 18:43 “3Leta e tell en savants, “Make yu go look di side wey di sea dey.” So di savant go look am kon kom back sey, “Nor-tin dey der.” Elijah kon send am go look again for seven times. Imagination na power wey person get to use mind form new idea, picture or concept about things wey eye nor dey see, or use mind create something wey never show. Imagination dey help person think, plan, remember, meditate or dream about something wey e never grab. No faith sometimes na because imagination nor dey work. As Ephesians 3:20 yarn, wetin you dey imagine? You fit call am fantasy but if your fantasy nor align with Bible way, e nor get better meaning. Imagination na big gift from God, na im resemble how God create us. Everybody get imagination, e dey show even for daydream, planning, memory, and meditation on God word. Philippians 4:8 talk say make we dey think about better thing. People dey talk say “your imagination dey hot!” Yes, because our Papa na creative God, we need i...