PIDGIN LET GO AND LET GOD!

Proverbs 3:5-6 “Make yu always dey trust God with all yor heart,
but nor trust wetin yu tink sey yu know. 6Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way..

 

To let go and let God mean say make you leave control, worry, and all your burden, then trust God fully to handle everything for your life. E mean say you go stop to dey struggle by yourself, stop to dey fear or dey hold onto your own plan, and instead you go allow God take over and do wetin e best for you.

Worry na sin just like lie and tiff. Worry na like say you dey pay interest on wahala wey never even happen. E dey show say you no believe say God fit handle your matter. But if you fit trust God for your salvation, why e dey hard to trust am for your daily need?

We suppose get faith for God, no be for our own sense or how we dey reason things. People wey dey always use their head to reason everything dey find am hard to get faith, and Bible talk say without faith, e no possible to please God (Hebrews 11:6).

Let Go: 

- Leave control for things wey you no fit change. 

- Forget fear, worry, pride, or past mistake. 

- No dey try fix everything by your own power—you no fit. 

- Surrender all your problem, plan, and desire give God.

Let God: 

- Allow God enter your matter fully. 

- Seek Him guidance, peace, and wisdom. 

- Trust Him time and way, even if you no understand. 

- Collect Him power, comfort, and presence.

Wetin you need let go today make God handle am for you? 

Many times we dey give God our problem, but after small time we go still carry am back try solve am by ourself. We go dey panic pray when wahala don set. The choice dey your hand to let go and let God.

You wan trust your life for God hand or you wan still dey hold am by yourself? 

Make up your mind today say you go let go all the things wey you dey hold, and trust God fully.

Believers na the most blessed people for this world. We dey pray to God wey be our Papa. He love us well well, e no go ever withhold any good thing from us (Psalm 84:11), just as e no withhold Him only Son.

When life hard you, to let go and let God mean say you stop to dey try control everything and you put your faith for God hand. E mean say you surrender your worry and collect Him peace, strength, and solution. Psalm 46:10 talk am: “Calm down, know say na me be God.” Sometimes to let go na to just relax and trust God to work.

You better leave the steering of your life for God hand, make He drive you for the road wey safe and sure, no be just anywhere breeze carry you go. Remember, only one person fit drive car at a time. Na either God dey drive, or na you. Both of una no fit drive together. But many people dey like hold the steering by themself instead of allow God.

When wahala or setback come, e dey easy to worry pass to relax. But try relax, allow God control your now and your future. Right now, give all your challenge and condition to God. Leave am for Him hand, no go carry am back. Remove your hand for the steering, let God drive. He sabi the road pass you.

Let go and let God.

PRAYER: Lord, abeg help me make I fit surrender control of my life give You completely, because I know say You get better plan for me. Na Jesus name I pray, amen.

https://creators.spotify.com/pod/show/womenoflight/episodes/PIDGIN---LET-GO-AND-LET-GOD-e34q4ed

Follow the FRESH MANNA CHANNEL on Telegram: https://t.me/freshmdevo

Follow the FRESH MANNA CHANNEL on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029Va8y5tqAjPXP6kZdoX1j

EMAIL: TEEWOMENOFLIGHT@OUTLOOK.COM

WOULD YOU CONSIDER PARTNERING WITH US TO REACH MORE PEOPLE? BY SHARING THIS MESSAGE ON YOUR PLATFORMS AND CONTACTS OR SOWING A SEED TO HELP US KEEP DOING THE WORK OF THE MINISTRY.

WE APPRECIATE YOUR GENEROUSITY AND SUPPORT.

SHALOM

Comments

Popular posts from this blog

IT IS NEVER TOO LATE TO START AGAIN!

DIVINE VISION!

RESISTANCE FROM STEPPING INTO PURPOSE!