PIDGIN GO TELL AM FOR MOUNTAIN!
Isaiah 52:7-10 “Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
8Pipol wey dey guide di
town, dey shaut as dem dey happy, bikos dem don si sey God dey kom back to
Zion.
9Jerusalem wey dem skata, make
una shaut dey happy, bikos God go save en pipol kon give dem peace.
10God go use en holy pawa
take save en pipol and di whole world go si am.
Dis phrase "Go Tell It
on the Mountain" get strong meaning for Bible. Anytime beta thing happen
for our life, e good make we shout am for everywhere, for up mountain, anywhere
people dey, so dem go sabi wetin God don do for us. E dey show say we dey happy
for wetin God do, and e fit make other people know say God fit do miracle and
bless person.
For church, we dey always
get testimony time or program, where people wey dey wait for God finally get
their breakthrough. Bible sef talk say make we dey encourage each other, and
the best way na to tell people how God don bless us.
Jesus talk for Matthew
28:19-20 say make we "go tell the good news" for everywhere for this
world.
“Go tell am for the mountain
top!”
"Go Tell It on the
Mountain" na the same thing wey Jesus tell Him disciples-make dem carry
the gospel go everywhere. Na wetin we dey call the Great Commission. E mean say
e good make we dey tell people about Jesus everywhere.
The popular Christmas song
"Go Tell It on the Mountain" na from the story of the shepherds for
Luke 2:8-20. After dem see say Jesus don born, dem begin tell everybody wetin
dem see and hear (Luke 2:17-18). Na so dem carry the good news waka everywhere.
E still join with the command wey Jesus give say make we "go into all the
world and preach the gospel to all creation," so make we dey spread the
message anywhere we dey.
Wetin you sabi? Wetin you
don hear wey suppose dey shout for mountain top?
Wetin God don do for your
life? Which miracle you don receive? Which breakthrough you dey enjoy wey fit
encourage another person?
The second verse for the
carol “Joy to the World” talk say:
Joy to the world, the Savior
reigns! He comes to make His blessings flow far as the curse is found!"
Jesus come make e remove
curse anywhere e dey. Think am for your life:
- The curse dey show for
shame and when dem dey oppress us.
- E dey show for injustice
and abuse wey we dey face from people.
- For all the hard work wey
nobody dey appreciate.
- For families wey don
scatter.
But the good news be say all
dis one no go last, Jesus go change everything when Him kingdom come.
But sometimes, we no dey
talk about the saving power of the gospel as we suppose. We suppose dey shout
am everywhere.
Bible talk say make we dey
share our story, testimony, and how God take help us, anytime we get chance, so
we fit bring people come meet Christ wey be Redeemer. Just as the watchmen for
Jerusalem dey sing with joy when dem see the Lord dey come, na so all believers
suppose dey talk about God for mountain top.
Go tell am for mountain-make
we dey talk the good news of Jesus Christ everywhere, just like the shepherds
for Luke 2 and as Isaiah 52:7 talk.
PRAYER: Papa God, give me
boldness and courage to dey talk and shout about your wonderful works and the
gift of salvation anywhere and anytime I fit, for Jesus name, amen.
https://creators.spotify.com/pod/show/womenoflight/episodes/PIDGIN---GO-TELL-IT-ON-THE-MOUNTAIN-e331teu
Follow the FRESH MANNA
CHANNEL on Telegram: https://t.me/freshmdevo
Follow the FRESH MANNA
CHANNEL on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029Va8y5tqAjPXP6kZdoX1j
EMAIL:
TEEWOMENOFLIGHT@OUTLOOK.COM
WOULD YOU CONSIDER
PARTNERING WITH US TO REACH MORE PEOPLE? BY SHARING THIS MESSAGE ON YOUR
PLATFORMS AND CONTACTS OR SOWING A SEED
TO HELP US KEEP DOING THE WORK OF THE MINISTRY.
WE APPRECIATE YOUR
GENEROUSITY AND SUPPORT.
SHALOM
Comments
Post a Comment