PIDGIN FRUSTRATION!
Isaiah 41:10 ‘So make una nor fear, bikos I dey with una!
Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear!
I go make una strong kon help una and I go protet and save
una.’
Frustration na wen pesin dey feel defeated, disappointed, and
like say e no get power to do anything. E dey pain when we wan do something but
e no gree happen.
I dey frustrated well well right now! Wetin be this kind
wahala sef? This frustration too much! We all sabi am, we don taste am before,
and e dey sad say sometimes na we dey cause am for ourselves and for other
people. Frustration dey show say no progress, success, or fulfilment don happen
as we hope.
Frustration dey everywhere—men, women, old people, young
people, everybody dey chop am one way or another. E fit make pesin feel weak,
defeated, disappointed, and empty.
Na real human emotion frustration be—e dey born from
expectations wey no happen, promises wey dey delay, or our desire wey dey clash
with God own timing.
Look Job case—Job suffer well, e confuse for wetin happen to
am (Job 3; Job 10). But even like that, e no turn back from God.
Moses sef dey frustrated as e lead Israelites for wilderness.
Dem dey complain, dey disobey—e tire am! As Numbers 11:10–15 tell us.
David cry for Psalm, say enemies dey progress, and justice no
dey show (Psalm 73:2–3, 21–22).
Paul carry thorn for body wey dey disturb am, but e later
understand say God grace dey enough for 2 Corinthians 12:7–10.
Frustration dey come as promises delay—like Abraham and Sarah
wey wait tire before Isaac come for Genesis 16.
John the Baptist begin doubt Jesus when e dey prison, as
Jesus no act like Messiah wey e expect (Matthew 11:2–3).
When frustration land, wetin we go do?
We go pray and open up to God. David, Jeremiah, even Jesus
for Garden of Gethsemane do am like that.
Proverbs 3:5–6 and Romans 8:28 dey remind us to trust God
plan even when the thing blur.
Psalm 73 show say as we enter God presence, we go leave envy
and frustration for joy and clarity.
Make we remember say anointing no dey stop frustration—Moses
wey get anointing still face big wahala.
Life na frustration plenty times, but out text talk say make
we no fear or confuse, because God hand dey always ready to hold us.
Frustration dey confuse person, e go make you feel say you
dey close to breakthrough but still far. Sometimes we dey frustrated even for
prayer—we go pray sotay e go be like say answer no dey come for James 4:3.
Joshua tell Israelites say make dem no discourage—God go
follow dem dey always (Joshua 1:9).
God dey give us strength and courage to waka pass frustrating
times.
Frustration dey follow pain and suffering, but how we take
manage am depend on who we trust—ourselves, people, or God according to Psalm
20:7.
Once we understand say some problems no get human solution,
we go learn to carry am give God. Na only Him fit help us as 1 Peter 5:7 talk.
We dey tunnel vision when we too close to situation and
forget say we get big God wey pass any wahala.
Even with discouragement, pain and sin, God still love us. E
still promise us and get better plan.
God for vex after Adam and Eve sin, talk say “I don tire for
una!” But instead, E give solution, love, mercy and compassion to carry us go
through frustrating seasons.
Everyday we dey wake up with one kind frustration and dey
wonder how we go survive without breaking down or giving up.
No fear! Look up to the One wey Him peace pass
understanding—make Him peace fill you reach overflow (Philippians 4:7).
No allow frustration chop you or steal your joy. Let God word
swallow frustration, and make the joy of the Lord strengthen you.
PRAYER: Papa God, give me grace and strength to handle every
frustrating wahala with wisdom. Make I allow You lead me pass am, in Jesus
name. Amen.
Follow the FRESH MANNA CHANNEL on Telegram:
https://t.me/freshmdevo
Follow the FRESH MANNA CHANNEL on WhatsApp:
https://whatsapp.com/channel/0029Va8y5tqAjPXP6kZdoX1j
EMAIL: TEEWOMENOFLIGHT@OUTLOOK.COM
WOULD YOU CONSIDER PARTNERING WITH US TO REACH MORE PEOPLE?
BY SHARING THIS MESSAGE ON YOUR PLATFORMS AND CONTACTS OR SOWING A SEED TO HELP
US KEEP DOING THE WORK OF THE MINISTRY.
WE APPRECIATE YOUR GENEROUSITY AND SUPPORT.
SHALOM
Comments
Post a Comment