PIDGIN ACHAN’S SIN!
Joshua 7
Israel pipol disobey wetin
dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi
born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon
dey vex for Israel pipol.
2Joshua send men from Jeriko
sey make dem go spy Ai town (Ai town dey near Bet-Aven, di east side for Bethel
land) e kon tell dem, “Make una go spy di land.” So di men kon go spy di town.
3Dem kom back kon tell
Joshua, “Nor send all di sojas go, about two or 3,000 sojas go distroy di whole
Ai town. Nor disturb di whole sojas, bikos Ai na small town.” 4So about 3,000
men kon go, but dem run from Ai men. 5Ai men kill about thirty-six from dem kon
porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail
dem like ice-blok wey dey melt.
6Joshua tear en klot; en and
di leaders for Israel fall for groun before di Kovenant Box until evening and
dem pak dirty full dia head 7Joshua kon pray, “My Oga God! Wetin make Yu take
us cross Jordan River kon give us to Amor pipol, so dat dem go distroy us?
8“Why wi nor just stay for
di oda side for Jordan River! Wetin I go tok naw wey Israel pipol dey run from
dia enemies? 9Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin
happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God,
wetin Yu go do to keep yor respet?”
10God ansa Joshua, “Make yu
get up! Wetin make yu face groun dey mourn? 11Israel pipol don sin; dem don go
against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from
Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty. 12Israel pipol nor fit
stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor
go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to
una.
13“Make yu get up! Go
santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro,
bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight
una enemies until una remove wetin make una dirty.”
14“ ‘Wen day break, una must
kom akordin to tribe. Di tribe wen God go choose go kom akordin to village. Di
village wey God go choose go kom akordin to family. Di family wey God go choose
must kom man by man. 15Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am
with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace
Israel pipol.’ ”
16Di next day for early
morning, Joshua kon tell Israel pipol make dem kom tribe by tribe and God kon
choose Judah tribe. 17Joshua sey make di pipol for Judah kom village by village
and God kon choose Zera village. Joshua sey make Zera pipol kom family by
family and God kon choose Zabdi family. 18Joshua sey make Zabdi Family kom man
by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey
bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.
19So Joshua kon tell Akan,
“My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive
mi at-all!”
20Akan kon tell Joshua, “Na
trut. I don sin against Israel God: 21From di tins wey wi karry from Jeriko, I
si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish
fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent
centre.”
22So Joshua send pipol go di
tent. Di tins dey for di tent and di silva dey under dem. 23Dem take all of dem
from di tent centre kon go give Joshua and Israel pipol kon put am for where
God go for si am.
24Den Joshua and Israel
pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu,
donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala
Valley). 25Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put
wahala for yor head today!”
So, evribody for Israel
stone en, en family and evritin wey e get until dem die finish, den dem kon
burn dem. 26Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and
God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.
Achan bad wahala! Na real
can of worms be this. Na serious wahala wey dey hard to solve, e touch
everybody join body for Israel. Sin be like fire, e dey burn reach every
corner. If person sin, e fit affect everybody for area, even people wey nor
sin. Sin nor dey small, nor be personal or secret, anything wey God nor like na
sin and e must get consequence.
You fit hide wetin you do
from people but you nor fit hide am from God as Luke 8:17 talk. For di story,
Israel people suffer because only one pesin do bad. But shame, disgrace, defeat
and death enter de camp because Achan sin spoil everybody.
Proverbs 28:13 talk say
person nor fit get better life if e dey cover im sin like Achan. God dey see
wetin you dey hide. You don ever do wetin God warn you make you nor do? Wetin
you dey hide so nobody go fit see am? If you dey hide sin, Heb. 4:13 talk say
God dey see everything.
Joshua sef confuse why war
nor go well for dem, but through God method, dem later find out say na Achan do
the thing (Joshua for verses 14-21.
God give clear command say
make dem destroy everything for city of Ai because the place dey bad. God talk
say carry only silver, gold, brass and iron go temple. But Achan nor hear word,
e go thief fine cloth from Babylon and silver and gold hide am under im tent.
Achan feel say nobody go catch am, but e soon open can of worms.
Because of secret sin wey
dey camp, Israel lose fight. Sometimes, we pray, try, but breakthrough nor
come, check well, wetin dey under your tent wey you dey hide? Wetin you dey
keep for corner fit dey cause spiritual problem.
Why Achan go collect Babylon
fine cloth and money? Na greed and want! This kind thing dey church today too.
God pin Achan sin to all im tribe till dem find out.
Achan thief from God! You
fit dey say “no be me, I nor dey thief, especially from God!” But check, you
dey do, give or talk less than wetin God ask you to do for tithes, offering or
help? Bible talk say we fit dey rob God with wetin we dey hold back for Malachi
3:8. If dem need your help and you turn face as James 2:16 and Proverbs 3:27
yarn, you dey like Achan too.
Achan Effect mean say one
person wahala fit spoil a whole group—family, team, and church. Secret sin fit
beef up wahala for ground.
Achan face punishment quick
and open. No play with sin, if you jam am, run go meet God confess and repent
as 1 John 1:8-10 command us.
Hebrews 3:13 talk make we
dey encourage each other so nobody go fall stay for ground. Accountability
matter, because one pesin wahala fit enter the whole body for Christ. God nor
wan sin at all, and make we nor allow am too, even small one fit open road for
bigger wahala, Galatians 5:9. Nor go open Achan own can of worms.
REFLECTION QUESTIONS
- Why e important to obey
God even when nobody dey look?
- How other people choices
don affect you?
- Wetin you go do if you
make mistake or do bad thing?
- How you fit help your
family or friends through better choices?
PRAYER: Baba God, abeg help
me obey You, make good choice. Help me dey honest and sabi say my actions fit
affect others. Thank You for forgiveness when I fall, for Jesus name, amen.
https://open.spotify.com/episode/4BVbOn9MORVPmuxNZLSGFe?si=Si2i6qb2TJCCLmx3BQxYNg
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
Comments
Post a Comment