PIDGIN FRINGE BENEFIT!
Romans 8:32 “True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!
Fringe benefit na wetin
person dey get on top of e main reward—like wen your work give you free medical
or car join your salary.
God give us the biggest
gift—Him only pikin, Jesus Christ, make e save all human beings. Since God fit
give us Him Son, e sure say nothing else wey e no fit give us. E show e love
and how e dey generous. If e no hold back Him pikin but allow am die for us,
how e no go give us other better things? Dis one dey make us trust say God go
always provide for us and take care of us.
Fringe benefit for spiritual
level mean all those extra blessings wey God dey give pass salvation. E fit be
answer to prayer, wisdom, comfort, food, healing—plenty things wey we dey enjoy
just because we dey close to God. Example, Psalm 103:2-5 praise God for all e
benefits—like forgiveness, healing, help, blessings.
Benefit get different
levels—special, normal, big company or personal. We dey enjoy am as we dey part
of different things.
As we dey enjoy some work
benefit because we be staff, so too, anybody wey dey for God's side dey enjoy
extra package. Fringe benefit for Bible na those “extra” blessings wey God dey
give wey no be say we work for am—na by God grace and e kindness.
For Bible, Solomon for 1
Kings 3:5–14 ask God for wisdom, but God give am wisdom plus money, respect,
and long life—extra blessings join because e get correct heart.
God dey always give us jara
when we trust, wait and obey am well. See as Job for Job 42:10–17, after all e
wahala, God bless am double of wetin e lose. E patience and faith bring healing
and better extra. If e don give up, e for miss am.
Many believers no enjoy
their own benefits because dem give up just before God go answer. Hebrews
10:35-36 talk say make we no throway our confidence because e get big reward.
After we do God will, we go get wetin God promise. If we stop halfway, we go miss
these blessings—just imagine if Job give up.
Ruth sef enjoy plenty fringe
benefit because she follow the right person. Ruth 2:11-12 show say as she
follow Naomi and trust God, she get food, protection, new family and even enter
Jesus family line—blessings wey pass wetin she expect.
Which benefit you dey enjoy
now because of where you dey, who you know or wetin you dey do? Me self dey
benefit from different people and places just because I dey do God work—na the
jara wey God dey dash me for serving am.
Fringe benefit still reach
transfer—like for Exodus 15:26, Israelites and everyone plus us wey dey believe
get health and safety from God if we obey am. If we waka with God, e dey give
us pass wetin we ask for—not because we too good, but because God too love us.
Jesus, wen e die for us, give us pass only salvation; special benefits still
full ground. Wetin you sabi or no sabi, get your own blessing join just because
you dey inside God family.
REFLECTION QUESTIONS
- Wich kind “fringe benefit”
you don enjoy because you follow God? Any blessing wey you no pray for but
still receive?
- E don ever happen say God
give you pass wetin you ask am? Wetin that one show you about God grace?
- Why you think say God dey
give us extra blessing pass just being saved?
- E dey happen say you dey
look pass the fringe benefit and forget to focus on your relationship with God?
PRAYER: Papa God, I thank
you as you dey loving and dey generous. You dey bless me with plenty things,
even pass wetin I ask or fit think. Make I no ever take your goodness for
granted, and help me use wetin you give bless other people, for Jesus name,
amen.
https://creators.spotify.com/pod/profile/womenoflight/episodes/PIDGIN---FRINGE-BENEFITS-e37fota
Follow the FRESH MANNA
CHANNEL on Telegram: https://t.me/freshmdevo
Follow the FRESH MANNA
CHANNEL on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029Va8y5tqAjPXP6kZdoX1j
EMAIL:
TEEWOMENOFLIGHT@OUTLOOK.COM
WOULD YOU CONSIDER
PARTNERING WITH US TO REACH MORE PEOPLE? BY SHARING THIS MESSAGE ON YOUR
PLATFORMS AND CONTACTS OR SOWING A SEED
TO HELP US KEEP DOING THE WORK OF THE MINISTRY.
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
WE APPRECIATE YOUR
GENEROUSITY AND SUPPORT.
SHALOM
Comments
Post a Comment