PIDGIN HOW MUCH?
1 Timoti 6:10 “Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.
When e come to life, na so
we dey think about wetin good and wetin bad. Things wey matter and no matter.
Wetin get value and no get any value. Life na one or the other: do or nor do,
fit or nor fit, yes or no, life or death. Na only one of these two fit stand.
How much money go do you?
How much go too much? How much go too small? How much you need to fit survive
every day, week, month or year? How much you need to get before you go talk say
you don arrive, say you don make am or say you rich? How dem dey take measure
person own worth? Or how much you think say you be? How much your life worth?
How much? How much e be? Na
the kind question we dey ask when we wan buy something.
For Bible, we see three
times wey money show face well. The first na Joseph story, wey im brothers sell
am for small change: dem sell am for 20 pieces of silver for Genesis 37. We no
know wetin dem use that money do, but e nor make their life better pass Joseph
own. If not, dem nor go come Egypt later come buy food, and dem nor go end up
dey bow to Joseph. So how much be 20 pieces of silver for dem?
Wetin the money change for
their life? And wetin e change for Joseph life? Because from Joseph story we
see say God raise am. Dem share the 20 silver, e nor reach anything compared to
Joseph greatness. If dem share that money, how far e go for eleven brothers?
Next na Samson for Judges 16. That story
still dey somehow. No be about all him wahala, but make we talk about Delilah
wey collect 5,500 silver coins from five kings. That kain money nor go make am
millionaire. Wetin thing 5,500 go fit buy? which person life reach that amount?
Your own life nko? You go sell your brother, your sister, your padi because of
5,500 pounds? Wetin e fit do? Today, e nor big at all. But na wetin Samson life
worth to Delilah and those kings. Dem pay that kind money to run evil. Dem pay
am to fight Samson, finish person wey be threat to dem.
Delilah collect the money,
why? Maybe to make herself better, to make people respect am, because e big
that time. Maybe to show say she get pass other women. Na wetin make her
collect that kind money we no know.
Now, make we talk about
Jesus Christ. Na only true love make am gree, and Judas sell am for only 30
pieces of silver. Na just 30 silver dem use value the precious blood of Jesus.
Judas, one of Jesus best padi, sell am for Matthew 26:47-56.
Even for church now, we see
say some people just dey go church, dem nor believe well, nor dey born-again.
Na so Judas be. Na im kind still dey church today. Judas dey among Jesus crew,
na trustee, na leader, yet e betray Jesus.
Jesus know wetin e dey do?
Yes, Jesus sabi am. But He still allow am so that Bible go come true. He allow
Judas dey there.
But na just 30 pieces of
silver? How much your own life worth? Think am. Na nothing! Because na the
precious blood of Jesus pay for your life. So, nothing wey you go fit pay cover
life.
No matter how we dey think
am for our mind, make we remember say Jesus blood carry big value pass all the money
for this world. No be money fit buy your soul. Na Jesus pay the price so you
fit dey free. Enjoy am.
Anytime you wan waka leave
God, anytime you wan do your own, think: how much your life really worth? So
you go sabi the true cost for your action.
REFLECTION QUESTIONS
- If dem wan sell you, how much dem go put for your head?
- How much go make you sell your loved one, friend or colleague?
- You don use good or bad reason "sell" Christ before? You remember
how e happen?
- Dem don ever sell you out before? How you feel that time?
PRAYER: Papa God, abeg help
me make I nor put money pass life or my good name. Help me see say money fit be
blessing but love for money fit bring wahala. Make I sabi manage money well. In
Jesus name, amen.
https://creators.spotify.com/pod/profile/womenoflight/episodes/PIDGIN---HOW-MUCH-e389tht
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread
the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more
people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
---
Comments
Post a Comment