PIDGIN KNOW THE SOURCE!
Judges 18:1-31 “Dat time, Israel pipol nor get king.
And Dan tribe dey find where
dem go stay, bikos dem neva fit pak go di land wey dem divide give dem, wen dem
dey divide land give all di tribe for Israel. 2So Dan pipol choose five strong
warrior from Zorah and Eshtaol town, so dat dem go find land where dem go stay.
Wen dis men rish Efraim hill
kountry, dem kon go stay for Mikah house till di next day. 3As dem dey Mikah
house, dem notis di Levi priest for der, so dem kon ask am, “Na who bring yu
kom here? Na wetin yu dey do for here and wetin make yu dey here?”
4E ansa dem, “I get agriment
with Mikah, to bi en pesinal priest and e dey pay mi.”
5Den dem tell am, “Ask God
for us weda awa journey go get head.”
6Di priest tell dem, “Make
una go in peace, bikos God dey with una for di journey.”
7So di five men kon go Laish
town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol;
dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey
produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight
with anybody.
8Wen di men kom back to
Zorah and Eshtaol, dia pipol kon ask dem, “Wetin una find?”
9Dem ansa, “Make una kom,
make wi attack dem! Wi don si di land and e dey very good. Wetin una dey wait
for? Make wi nor waste time, make wi go take am. 10Wen wi rish der, una go si
sey di pipol dey leave eazy life. Di land big well-well and e get evritin wey
pesin wont. God don gi-am to us.”
11So six hundred men from
Dan tribe wey ready for war kon komot go Zorah and Eshtaol. 12Dem kamp for
Kiriat-Jearim west for Judah and na dis make dem dey koll di place Dan till
today. 13Dem from der pass go Mikah house for Efraim hill kountry.
14Den di five men wey go spy
Laish land kon tell di oda pipol, “Dis house wey una dey si so, get holy
garment and some oda juju wey dem karve, dey der too. Wetin una wont make wi
do?” 15So dem enter Mikah house where di yong priest dey stay kon greet am well.
16As di six hundred men from Dan tribe wey ready to fight war, stand for di
gate to enter di kompond, 17di five men wey go spy, enter di shrine karry di
image wey dem karve, di efod and di juju dem. While di priest stand for di gate
with di six hundred men.
18Wen di priest si sey di
men dey karry di holy tins dey komot from di shrine, e kon ask dem, “Wetin una
dey do so?”
19Dem ansa am, “Kwayet and
make yu follow us kon bi awa papa and priest. E nor good sey make yu bi priest
for Israel tribe and family, down for one man?” 20So di priest happy kon follow
dem and e karry all di holy tins. 21Dem kon dey go with dia shidren, animals
and all wetin dem get.
22Wen Dan pipol don go far
from Mikah house, Mikah kon koll all en neighbours make dem follow am porshu
Dan pipol. 23Dem porshu Dan pipol katch. Den, Dan men turn back kon ask Mikah,
“Wetin happen? Why yu koll all dis men make dem porshu us like dis?”
24Mikah ansa, “Wetin una
mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey
go, wetin remain for mi naw!”
25So Dan men tell am, “Mind
wetin yu dey tok! Unless yu wont make all dis men attack kon kill yu and yor
family.” 26Den, Dan pipol kon waka dey go. Wen Mikah si sey di pipol too many
for am to attack, e kon leave dem go back to en house.
27Afta Dan pipol don take
Mikah holy tins and priest, dem kon rish Laish land where di pipol dey kwayet
well-well. Dem attack dem with swod kon burn di town rish groun. 28Nobody dey
to save dem, bikos dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor get any
business with oda pipol.
Den, Dan tribe build di
place kon dey stay der. And dis tin happen for di valley near Bet-Rehob. 29Dem
shange di town name from Laish to Dan, bikos of dia grand-grand papa wey bi
Jakob pikin. 30Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin,
dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go
Babilon. 31So Mikah juju dey der, as long as God Tabanako dey for Shiloh.
Wetin be the source of your
belief? You sabi am? Sometimes we dey find God all over but no dey find am for
the correct way. We no dey follow 1 John 4:1-2 wey talk say make we test every
spirit, or prophecy wey dem talk. Plenty times, our mistake na say we no dey
follow Spirit of God. Sometimes na laziness or ignorance make we miss God best
for us when we dey do things and plan outside God will and word.
Dan people no fit take the
land wey God give them because dem lazy and fear for verse 34. So, dem just dey
waka here and there dey look for place to settle. Plenty Christians too dey get
vagabond spirit, dem no get home church because of one kind excuse or another.
E worse when Dan people find one vagabond Levite wey no dey follow God well as
their priest.
We get to day careful not to
accept any prophecy or word from any "man of God," especially if the
man of God no dey for the correct place. This priest na one wey dey serve only
one man for money and no dey serve for temple. E steal from e mama for Judges
17:2, come still get metal idol wey e dey worship.
The priest dey for one right
place by chance when Dan people go find am, but no be for God. Enemy go always
put fake things for our way to stop us from the plan wey God get for us.
Make we dey test all
spirits, and test all words to know the source. If word no agree with God word
or scripture, no be God word and you get to question am or throw way am. The
story of the old prophet and man of God for 1 Kings 13 na another example of
knowing the source. Man of God get direct order from God, but old prophet talk
say angel tell am someting different and e deceive am. Which one pass? God or
angel?
True wisdom and discernment dey
come from God word. If we sabi Bible well and dey apply am, we go sabi judge
all other things as we see for Acts 17:11 and Hebrews 4:12.
Dan people choose to ask
help from wayo god, something wey God no like. Then dem make matter worse when
dem carry the wayo priest join dem and bow down to the idol wey imdey serve too.
When we no find answer from God,
as we wan quick solution, we fit accept any word wey sound good or spiritual.
The priest talk say "Go in peace, your journey get the Lord
approval," but na when e check with the Lord? Where e hear God talk? This na
the kind answer wey people want hear, many of us dey do am too. We must know
the source!
Why God go change im own
land promise wey e give for Joshua 19:40-48? Dan people no fit enter their
blessing because dem no make effort.
Bible talk say to know if
message, teaching or spirit come from God no be small thing. We must test am
well with scripture and dey pray say make Holy Spirit guide us, so we go fit
follow only wetin God approve.
If you sabi the Lord, you go
sabi the source too.
REFLECTION QUESTIONS
- How often you dey check
the source of the prophecy or teaching wey you dey hear?
- Which kind step you fit
take to dey sure say the word na from God?
- You don ever accept
something wey you think na God word but e no really be? Wetin you learn?
- Why you tink say God want
make we always test and check every teaching before we accept am?
PRAYER: Lord, I dey ask for
better wisdom, better understanding, and discernment to guide me as I dey test
every spirit for this waka of life, for Christ name, amen.
https://open.spotify.com/episode/6fvEaZdIISLMYY2QmINc46?si=Q0Gd_WVMTWeNRf-34iI8Zw
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
Comments
Post a Comment