PIDGIN- LESSONS FROM SAMSON STORY
Judges 16
One day, Samson go Gaza wey
bi Filistia pipol town and e stay der thru-out with one ashawo. 2Gaza pipol kon
know sey, Samson dey for der, so dem gada for di town gate dey wait for am till
day break. Dem sidan kwayet dey tok for dia mind sey, “If morning rish, wi go
kill-am.”
3But Samson stay bed go rish
mid-nite, den e get up go di town gate pul am with di two pila kon karry am for
en shoulder go Hebron hill.
Samson and Delilah
4Afta sometaim, Samson kon
love one woman wey en name na Delilah, wey dey stay for Sorek Valley. 5All di
five rulers for Filistia go meet Delilah kon sey, “Make yu deceive Samson, so
dat e go tell yu wetin make am dey strong and how dem fit take stop am. Den yu
go find way take tie am with rope well-well. Afta evritin, each of us go give
yu 1,000 one hundred silva.”
6So Delilah go meet Samson
kon tell, “Abeg, make yu tell mi, ‘Wetin make yu dey strong like dis and wetin
pesin go fit do, if e won tie yu?’ ”
7Den Samson ansa, “If dem
tie mi with seven new strong rope wey nor dry, I go dey weak well-well.”
8So Filistia rulers bring
seven new strong rope kon give Delilah, den e use am take tie Samson. 9By dat
time, Delilah hide some men for di oda room, den e shaut, “Samson! Filistia
pipol don kom katch yu o-o!” But Samson kut di rope, just as tread dey kut if
yu take fire tosh am. So dem nor still know di sekret wey make am get pawa.
10Leta, Delilah kon tell
Samson, “Si, yu dey lie for mi kon make mi bi like fool! Abeg, make yu tell mi
di trut, na how dem fit take tie yu?”
11Samson ansa am, “If dem
tie mi with new rope wey dem neva use before, I go weak well-well.”
12So Delilah take new rope
kon tie am. Di men dey di oda room dey wait, so e kon shaut, “Samson! Filistia
pipol don kom katch yu!” But e kut di rope komot for en hand like sey na tread.
13Den Delilah tell am, “Yu
still dey lie and fool mi! So naw, make yu tell mi how pesin fit take tie yu.”
Den Samson ansa am, “If yu
plait my hair into seven part kon use peg take make am tit, I go dey weak
well-well.” So wen Samson dey sleep, Delilah kon plait di hair into seven part.
14Den e tit am with di peg.
E kon shaut again, “Samson!
Filistia pipol don kon katch yu o-o!” So Samson wake-up, remove di peg, den luz
en hair.
15Den Delilah vex kon tell
am, “Why yu dey tell mi sey, ‘I love yu’ and yu nor fit trust mi kon tell mi
yor sekret? Yu don fool mi three times naw and yu neva still tell mi wetin make
yu dey strong!” 16Delilah kontinue to dey tok and komplain until Samson kon
taya for en wahala, 17so e tell am di trut at last.
E sey, “Dem neva kut my hair
wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut
my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”
18Delilah just know sey
Samson don tell am di trut, so e send message go give Filistia rulers sey,
“Make una kom back just dis last time, bikos e don tell mi di trut.” So dem
bring di money follow body kom. 19Delilah deceive Samson sleep for en lap, den koll
one man make e kut di seven hair komot. Den e put am for groun small-small,
bikos en pawa don leave am.
20Den e shaut, “Samson!
Filistia pipol don kon katch yu!”
E wake-up kon tell ensef, “I
go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga
God don leave am.
21So Filistia pipol katch am
kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force
am make e dey grind korn for prison. 22But e nor too tey, before en hair kon
dey grow kom again.
23Filistia rulers dey do
party, offa sakrifice and dey praiz dia god wey bi Dagon kon dey sey, “Awa god
don give us viktory ova Samson wey bi awa enemy!”
24Wen di pipol si am, dem
praiz dia god sey, “Awa god don diliver awa enemy give us! Di pesin wey kill
many of awa pipol don dey under awa pawa naw!”
25Many of dem don drink by
naw, so dem sey, “Make una bring Samson kom out make e kon make us laf!” So dem
bring am kom out from di prison and e stand between di two pila wey dey support
di building. Dem kon dey play with am, so dat e go make dem laf.
26Den Samson tell di boy wey
hold en hand sey, “Make yu put my two hand for di pila wey hold di temple,
bikos I won rest my body.” 27By dis time, di temple don already full with
pipol. All di five Filistia rulers dey der and about 3,000 men and wimen dey
der dey wosh Samson as e dey make dem laf. 28Den Samson pray give God sey, “Oga
God wey get pawa, remember mi again. My God! Abeg make Yu give mi pawa one more
time. Make I pay Filistia pipol back for my eye wey dem blind.” 29Samson put en
two hand for di pila wey hold di temple kon push am, 30den e pray sey, “My God,
make Yu allow mi die with Filistia pipol wey bi my enemies.” Den di temple fall
skata for di five rulers and di pipol head. Di pipol wey Samson kill wen e dey
die, many pass di ones wey e kill wen e dey alive.
31Afta, en brodas and family
kon karry en dead body. Dem take am go beri between Zorah and Eshtaol, where
dem beri en papa Manoah put. Samson lead Israel pipol for twenty years.
You don ever ask yourself
where you dey go? You dey exactly where God want you dey? You dey do wetin God
want make you do? Some people dey do wetin dem think dem suppose do, some dey
follow wetin God talk, others dey do wetin their body tell dem to do.
Samson no dey where e
suppose dey. E choose to dey with one ashawo for Gaza, and that one put am for
danger from Philistines wey dey wait to kill am. You dey safe because you dey
where God want you dey, or you dey exposed because you stray? Samson no dey
safe because e no dey where e suppose dey. If you no dey where you suppose dey,
no protection dey for you.
Philistines gather quietly
just dey wait to catch Samson for ambush. Their silence na bad plan—but silence
fit be time to hear God well well. Learning to gerrit quiet and hear God na the
key. Sometimes na for silence God message go come. Dem gather dey wait all
night. Who dey gather against you? Why dem dey gather? If you dey where you
suppose dey or where you no suppose dey, God go save you from hand of dem wey
gather against you?
Dem no talk! Dem gather all
night, but dem quiet. But for our own case, no be say we suppose quiet for all
time, even for church some times. As women too, we dey talk plenty. Sometimes
you gerrit tell yourself, shh! Because na when you silent you go fit hear
whispers wey dey your side. If you silent, you go hear voice of the Lord clear
clear. If you silent, your mind go clear and you go fit focus well. Talk plenty
sometimes no good.
E talk say, “When morning
light come, we go kill am.” Their silence na silence to think and plan evil.
You sef fit gerrit quiet with your mind dey think, dey meditate on who your God
be. How many sabi gerrit alone for at least 20 minutes without TV, radio or
music sound? Not plenty! Learn to stay quiet when e reach time to dey quiet
because na when you quiet, na then you fit hear wetin you suppose hear when you
dey where you suppose dey.
Delilah waka enter Samson
life and Philipstines give am money to betray Samson. She gather money to find
secret of im strength. Samson, even with warning, still dey fall for her trap
because im love and trust dey the wrong place. Love fit carry person go where
person go weak if person no careful.
Samson dey for "valley
of Sorek." Sorek mean grape. You dey get your wine from where? You dey get
your olive oil from where? How dem take get all those things from grape? Na
crush dem crush am. Look Samson now, him dey for valley where them go crush am.
Na you waka use your leg go place wey you no suppose dey, tell yourself say you
dey in love. Love carry Samson go place wey e no suppose dey. Na there enemy find
am. Where you dey? You dey where you suppose dey, dey hide inside God or you
don expose yourself to enemy?
We no go sabi wetin we dey
do till we dey for God presence and we beg for God presence. Samson no serious
with im strength. Samson no serious with God's order. Samson full of pride,
lust and world matter. You too nko?
Even so, Samson cry to God
for strength one last time and tear the temple, kill many enemy, but still die
with them. God fit restore strength and purpose after failure.
No matter where you dey, God
no finish with you. Like Samson, if you humble and seek God, God fit still use
you well well.
REFLECTION QUESTIONS
- You dey hear Lord with
your heart or your ears or both?
- You don try dey quiet
before God and hear am clear before? How e change your faith?
- You get one time wey you
ignore wisdom and e cause wahala?
- You believe say if you no
dey where you suppose dey, you dey exposed?
PRAYER: Lord, deliver me
from wahala wey dey valley of Sorek. Deliver me from hand of people wey dey
hide for dark dey wait for me for silence. Deliver me from all wey dey plan
wahala for my life, family, house, pikin and ministry for Jesus name, amen.
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread
the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more
people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
Comments
Post a Comment