PIDGIN A BOX OF USELESS GIFT!
Proverbs 18:16 “If yu won go meet important pesin, den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.
You ever don collect gift
wey just make you feel somehow? Maybe the gift no fit the occasion, too cheap
or too expensive, or just no get meaning for you. For real, that kind gift ndey
useless to you. Gift suppose to make person happy or be blessing, but e nor
always dey like that.
Gift wey person give suppose
come from heart, not because say dem force you, but because you wan bless
another, as Bible talk for 2 Corinthians 9:7, “make una give wetin una fit, not
by force, because God like person wey dey happy to give.” No be every time we
go say “na the thought dey count” - sometimes e nor count.
Useless gift na that one wey
nor mean anything to the receiver. Sometimes people dey give gift because say
dem wan showoff, or dem wan impress others, or just to fulfill all
righteousness, not because of love. The gift fit fine for eye, but e empty for
meaning.
For one time, because of
work, I receive plenty gifts from people - clients and their family. I gather
all for one box for safe keeping so e nor go scatter everywhere. When I come
dey sort am one day, I realize say most of the gifts nor get use for me, but
maybe e mean plenty to those wey give am.
Useless nor mean say e no
get value at all! When I check am, I see say some people give me gift wey mean
something to them, but nor mean anything for me. One time, person give me fine
lighter, but I nor dey smoke, so that kind gift na useless and worthless gift to
me.
Gift dey sweet if person fit
use am. Gifts dey build friendship and open doors. Dem dey show love and
kindness.
Jesus talk for Luke 6:38
say, “Give and e go come back to you. Good measure, pressed, shaken,
overflowing” - blessing nor dey just for gift, but na joy, peace and favour wey
dey follow good giving.
Gift na symbol of love,
commitment and care. When you find perfect gift for person, the happiness dey
plenty when you see am dey use am. Na so God dey treat us, He give us special
gifts - spiritual and physical - wey dey build church and bless plenty people.
God dey happy when we use all the gifts well, for Him glory.
God gift to us no dey
useless - James 1:17 talk say God dey give “good and perfect” gift. God start
with Him biggest gift - Jesus. Because of love, John 3:16 show say God gift
Jesus to world. This love mean we dey collect different gifts from God - spiritual,
physical, financial, material as Psalm 84:11 say.
You don ever collect or give
useless gift before? I throw way many wey nor good for anybody, but the ones
wey I fit give to people wey need am, I do so.
Wetin dey useless to you fit
dey useful for another person. No ever look down on your own gift, especially
your spiritual gift. Na God give us the best gift, na Him be ultimate giver. 2
Corinthians 8:12-14 talk say make you give according to wetin you get!
REFLECTION QUESTIONS
- Why you dey give gift - to
show people or to show love?
- You don ever give
something wey you nor mean before? How you feel?
- Wetin dey make gift
valuable - for God, for you, or for another?
- If God open your “gift
box”, e go find good gift like love, kindness, obedience or just empty things?
PRAYER: Papa, help me learn
to dey give better, useful and valuable gift to honour you and bless the
receiver for Jesus name, amen.
https://open.spotify.com/episode/2yFqAu4Wj3HGEMNt9Hf6Qy?si=--wCJfEnSH-9V2M0LnXQ5w
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
Comments
Post a Comment