PIDGIN IMAGINE!
1 Korintians 8:2 “Di man wey tink sey e know sometin, neva still know as e suppose know.
Imagination na something wey
everybody get but many people no dey use am, sometimes because dem no sabi or
dem dey use am anyhow. Imagination na the first step for person to become
anything! Your mind dey see, hear, feel and achieve spirit things before you do
am for real life.
Imagination mean say you dey
form ideas or picture for your mind—vision wey you dey see for spirit. Na to
draw image for your head, to think or plan for your heart. E still mean to dey
reason strategy or arrange project, as Psalm 62:3 talk.
Imagination na strong tool
wey fit make you see wetin you really want for life. Even though Bible na real
word, na our imagination with faith make the word come alive by Holy Spirit
power. The Word sef become flesh dwell inside us, but Him gats become flesh for
our heart and mind to give our imagination true meaning, na John 1:14 talk am.
Imagine say Noah no gree
build Ark for Genesis 6:14-17.
Imagine, if God leave the
people make dem complete Tower of Babel. Genesis 11.
Imagine say Abraham no
travel as God command. Genesis 12:1-4.
Imagine if instead of Joseph
brothers selling am, dem kill am. Genesis 37:12-31.
Imagine if Jacob no believe
say Joseph still dey alive and no waka go Egypt see am. Genesis 46.
Imagine if na Moses dem
anoint as Pharaoh—most powerful man for e time. Hebrews 11:24.
Imagine if Saul still dey
king for Israel instead of David. 1 Samuel 16.
Imagine if Ruth follow Orpah
go back Moab. Ruth 1:14.
Imagine if Jonah reach
Tarshish, no go Nineveh warn dem. Jonah 1.
Imagine if Mary think say
Angel Gabriel na lie, she nor gree or no accept to be chosen. Luke 1:26-38.
Imagine if Joseph jilt Mary.
Matthew 1:18-24.
Imagine if Jesus fall for
devil temptation. Matthew 4:1-11.
Imagine if John the Baptist
birth no happen as Isaiah 40:3 talk.
Imagine say Zechariah fit
talk back after angel visit. Luke 1:5-24.
Imagine if the disciples nor
follow Jesus when he call dem. Matthew 10:1-4.
Imagine if Judas Iscariot be
better guy, no betray “friend”. Luke 22:47-48.
Imagine if Jesus no pass
through betrayal, trial, flogging and crucifixion or burial. Matthew 27.
Imagine if Jesus no
resurrect. Matthew 28:1-8.
Imagine if Jesus no climb go
heaven. Luke 24:50-52.
Imagine if to enter heaven
you no need to born again. John 3:4-5.
Imagine if power and name of
Jesus no dey for our side. John 14:13-15.
Imagine if Holy Spirit no
show as dem promise. Acts 2:1-13.
Imagine if Paul no meet
Jesus or turn Christian. Acts 19:5-6.
Imagine if salvation no dey
important again. Romans 10:5-21.
Imagine if Word of God no
dey. 2 Timothy 3:16.
Imagine if faith nor make
sense. Hebrews 11:6.
Imagine if death and
judgement nor dey. Hebrews 9:11.
Imagine if hell true wey
even angels wey fall nor fit escape. 2 Peter 2:4.
Imagine say heaven real as
Bible talk am, and na only believers fit enter. Revelation 21:4. You fit risk
miss am?
Imagine say all you think
you sabi no be truth. Imagine say you choose no believe, accept or follow
Jesus—fit imagine eternity without am?
REFLECTION QUESTIONS
- Which Bible story dey wow
you pass whenever you imagine am?
- You fit picture yourself
inside one Bible story—like pass through Red Sea or see Jesus dey feed
thousands?
- How your imagination dey
help you believe God promise reach?
- You fit imagine the kind
person wey God want make you be? Wetin you see?
PRAYER: Baba God, help me
dey imagine your word and believe the wonderful things wey you fit do. For
Jesus name, amen.
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
shalom
Comments
Post a Comment