PIDGIN EVIL RECRUITMENT!
Efesians 5:11 “ Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.
From
Genesis to Revelation, di Bible call God people make dem no join for any evil
matter, no matter how e soft or hard to join. To resist na to honour God, protect
your soul, and shine light for dis dark world.
Evil
recruitment mean say pesin or group dey try charme, do anyhow, or use spirit to
pressure person join bad bad wicked work. Dis word dey mostly for story, crime,
cult matter, or extremist tins, but e also dey real life where pesin dem dey
enter bad bad wahala, wicked groups, bad spirit or bad evil people.
For
one time for life, we don all face dis matter where pesin go tell you not to
talk or join some people because your friend, family or work mate no dey cool
with dem. Na dis one I dey call "evil recruitment"! E mean say people
or group dey find pesin to join for bad, wicked, or malicious tins. Apostle
Paul warn us for 1 Corinthians 15:33, say if you link with people wey dey do
bad tins, e fit carry you go their own way.
True
wisdom according to Proverbs 3:7 na say make you no kuku join wickedness, even
if people wey get power or your peers dey push you go do wrong, loyalty to God
suppose come first like we see for Acts 5:29 - "We must obey God rather
than men".
Quarrels
dey come from foolish tins or passion wey don settle for inside pesin like we
see for 2 Timothy 2:23-24 and James 4:1-2. Why you go fight with pesin wey
never offend you, just because dem get wahala with your friend? Stand make you
comot for wicked work”
Proverbs
30:3 tell us to avoid fight and say na fool dey quick quarrel, show say e
better make person avoid trouble. But many pipo dey get caught like pig inside
fight wey dem no sabi from where e start. Dem join fight wey dem no start but
fit end with dem.
discernment
for relationship dey important. We must sabi when invitation, chance, or
partnership get wicked ground, even if e look like say e good or e go help
relationship. If we no get discernment, e easy to join fight wey fit follow
family or people generation like we see for Genesis 37 - Joseph brothers’
malice for am and their generation after.
Quarrels
start small but fit blow like dam wey burst, wise person go solve or avoid
fight early like Proverbs 17:14 talk. You no quarrel with pesin but you no talk
with dem because dem get quarrel with your friend. If dem settle fight, e fit
still end for malice, malice wey no get base. Bible warn say no join fight wey
no be your own or no make trouble, see Proverbs 26:17 and Titus 3:9-11.
For
malice and quarrel, Ephesians 4:31 talk say make we comot all bitterness,
anger, wrath, clamor, slander, and malice. Also, 1 Peter 2:1 talk make we get
rid of malice, deceit, hypocrisy, envy, and slander. Malice dey come from
matter wey dey between people. Why we go gree say make we join for bad thing
wey no really concern us?
Make
we get courage! Make we get courage say we no go join tins wey no concern us
but make e glorify God or make e build others. Evil fit bring shame, loss, or
suffering but God dey honour person wey stand gidigba. To refuse to join bad
bad tins na not just for your own protection, na sign wey show say God way
better.
If
you gree join evil, e go spoil relationship, cause bad tension, spoil church or
group unity, and fit mean sin like selfishness to get more according to Galatians
5:15 and James 4:1-2.
REFLECTION
QUESTIONS
-
How I fit join anyhow for evil recruitment by supporting gossip, division, or
malice wey I know no?
-
How I fit stand firm for righteousness even when I stand alone?
-
Wetin I fit do to make sure say I no be source for fight but I be peacemaker
for family, church or work?
-
I don allow bitterness or malice grow for my heart because of how pesin vex me
before?
PRAYER:
Papa God, I dey beg You make You give me sense to sabi any kind evil
recruitment, even if e dey hide. Make You give me power to stand well for
righteousness and make I no dey shake because of wetin people talk or how dem
take vex me. Use me as instrument wey go bring healing, unity, and peace
anywhere I waka go. I pray in Jesus name. Amen.
We
invite you to prayerfully consider partnering with us to keep sharing the
gospel and touching lives.
you
can support this ministry in two simple ways:
✅ share
this message on your platforms and with your contacts to spread the word.
✅ sow a
seed to help us continue the work of the ministry and reach more people for
Christ.
follow
the fresh manna channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow
the fresh manna channel on WhatsApp:
https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
your
partnership makes a difference! together, we can impact lives for god’s
kingdom.
we
appreciate your generosity and support.
💳 Bank
Details for Contributions
Bank
Name: Barclays Bank
Account
Name: B. Okoh
Sort
Code: 20-10-71
Account
Number: 53178420
PayPal
account: prodbyjayt1@gmail.com.
shalom
Comments
Post a Comment