PIDGIN KEEPING UP APPEARANCES!
John 7:24 “Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”
You don ever watch that
British comedy wey dem call Keeping Up Appearances? Na about Mrs Hyacinth
Bucket, wey she dey pronounce as Bouquet. Her own na how she go dey use
appearance do everything. Hyacinth go go church cleaning day for her best
cloth, she no go clean anything—her own na make dem notice am. Na only the big
and important work she want to do.
Shakara fit deceive person
well well sha, most people only see wetin dey outside. To judge book by cover
na another way wey people dey use take value person or thing wey no be the real
thing.
To dey keep up appearance
mean say person dey hide real self—dey project pretend version. But disguise no
dey move God. The heart, inside matter pass to God. God want make we show real
beauty, beauty wey reflect am, as 1 Peter 3:3–4 talk.
Na so Samuel do when God
send am go Jesse house to pick king for Israel for 1 Samuel 9:2, Samuel just
look Eliab come tjink say na him God pick.
Just like Mrs Bucket, we all
dey try keep up appearance for some side of our life, sometimes na mistake,
sometimes na everything, and especially when e reach festive season.
Jesus warn us make we no
judge wetin person do or no do, from physical look. To dey keep up appearance
dey risky because e dey come from deception. Na to pose like wetin you no be.
Who you dey try impress? Man or God?
To dey keep up appearance
mean say you show artificial character wey dey cover who you really be. We dey
wear mask, dey behave way wey hide our real self so we fit blend with people.
Many people own reputation and wetin people think fit no match wetin dey inside
them.
God no dey look the outside.
For God, na wetin dey inside person dey important pass. Bible talk say, make we
develop inside beauty so e go show for everything we do, and show who we
be.
To judge person by wetin dey
outside no correct. See Jesus, God pikin come earth as man. People no even
notice by just look, dem crucify am. Dem no even try look past wetin dey
outside to see inner beauty and holiness as Matthew 23:28 show.
We fit spend money for gift
to make someone happy or stay on good side, meanwhile heart full of anger and
hate.
World wey we dey live na
place wey people dey focus for surface matter. We go like to say na only few
dey look past wetin dey outside, but mostly apperance dey influence us, as
Matthew 7:20 talk. Wetin be our focus: weight, cloth, make-up, money, or
God?
We go balance appearance
with sense. Bible say make we present ourselves well, but God no tell us make
we overdo. Make we be correct model of character wey bible teach, as Proverbs
31:30 talk, make we know why we dey do wetin we dey do.
Make we no act like the world
wey dey focus for wetin fine for eye or draw attention to themselves, as 1 John
2:15–16 talk.
Christian life and our
witness suppose reflect for our appearance, as 1 Timothy 2:9–10 show. Make we
wear decent and correct cloth as people wey represent Christ and avoid wetin
fit confuse people for wetin we stand for. Abeg, keep am real!
REFLECTION QUESTIONS
- For which side of your
life you dey quick wan “keep up appearance”?
- How you see the way God
dey reason your outer look and inner character?
- You don ever judge person
by wetin you see for outside or how dem behave outside?
- Any “mask” dey wey you
feel say God wan make you drop?
PRAYER: Baba God, help me
make I no just dey follow world way but make I dey chase that inner beauty wey
dey please You. Teach me make I dey see other people with Your eye, with
compassion and mercy, no be with judgement, so I go glorify You and help point
others to Your truth. I give You my image, my rep, and my heart, in Jesus name,
Amen.
https://open.spotify.com/episode/7GLLe3aBgT2t2BOq23YiF6?si=BdwdyElIQ6e0Om0FpFxv_A
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
email:
teewomenoflight@outlook.com
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
Shalom
Comments
Post a Comment