PIDGIN LONGING!
Psalm 42:1-2
My God, just as deer dey find wota to drink,
na so too I dey find Yu.
2I dey hongry to know God!
Di God wey dey alive.
So na wen I go take stand for en front?
Sometimes, person fit get
one kind ache for inside heart wey words no fit explain, the ache wey dey pull
for soul, dey stretch the heart toward something wey pass wetin our eye fit
see. This na longing. This longing no be weakness, e no mean say you lack
anything for life; na sign say we need more than wetin we dey see.
Na that same longing for
more make me find faith — longing for wetin pass the dry, traditional routine
of church life wey no dey satisfy soul (Hebrews 5:12).
Longing don exist from
beginning of human story. Adam long for companionship before Eve come. Abraham
long for promised land wey e never see. Hannah long for pikin. David long for
God presence more than water for dry land. Paul long to know Christ and the
power of His resurrection. Even creation itself, like Romans 8:19 talk, dey
“groan with eager longing” for redemption.
Longing no mean say
something wrong with you. E mean say something right inside you — say your
heart still dey alive, awake, and dey reach out to the One wey put eternity
inside you (Ecclesiastes 3:11).
Longing dey show the depth
of our desire, as David talk for Psalm 84:2. This one no be small wish — e be
deep hunger, thirst, and the ache of heart wey know where home truly dey.
So, ask yourself: wetin you
dey long for? Where your real home dey?
Longing dey expose wetin we
value most. E show wetin we dey hope for. E open up the places where our soul
no gree settle for counterfeit.
When David long for God, no
be because blessings no dey — he get success, honour, and power. But nothing
satisfy that deeper ache inside am.
Longing na the soul way of
saying, “Only God fit fill this space.”
Abraham live with longing.
Hebrews 11:10 talk say he look forward to the city wey get real foundation, wey
God na the builder. He waka through dry desert with promise for him heart and
longing for him spirit.
Longing na wetin make us dey
move, believe, and stretch toward wetin God plan for us.
Joseph long for freedom
inside prison. Israel long for deliverance for Egypt. Simeon long to see the
Messiah — and God honour that longing make e hold salvation with him own hand for
Luke 2:25–32.
God no despise your longing.
He dey honour am, shape am, and use am draw you nearer to Himself.
Longing go teach us how to
wait well, just like Psalm 130 talk — to wait for the Lord and hope for Him
word. To wait no be to fold hand and do nothing; na active trust.
Longing without hope fit
turn to despair.
Longing with hope go turn to
worship.
Hannah longing push am go
temple. Anna longing keep her fasting and praying for years.
To wait well mean make you
allow longing to refine you, not break you.
Longing always point us go
God presence. Because for the root of every longing — even the ones wey no look
spiritual, na deeper longing for God Himself. The desire for love, purpose,
justice, healing, or peace all lead back to Him.
The deer for our text no
just dey thirst for water — e dey long for survival, refreshment, and life. Na
so we too dey long for God wey dey sustain our life.
When we carry our longings
come meet God, we go realise say He no just dey fulfill desire — na Him be the
fulfilment.
God no dey wait make your
longing finish before He come meet you. He dey meet you inside am. He dey
strengthen you through am. He dey use am transform you.
Even Jesus experience
longing. He long to gather Jerusalem like mother hen dey gather her chicks
(Matthew 23:37). He long for the joy wey dey before Am, our salvation (Hebrews
12:2). He long make we dey with Him where He dey (John 17:24).
So, if Jesus Himself long
for, that means longing no be flaw, na
holy invitation.
REFLECTION QUESTIONS
· Which
longing for my heart God dey use draw me close to Him?
· How
I don dey respond to seasons of waiting — with trust, frustration, or
surrender?
· Which
desires I need drop back for God hand make He shape am Himself?
PRAYER: Lord, You see every longing inside my heart — the one wey I talk and the one wey I never talk. Teach me to wait with hope, to trust Your timing, and to find my deepest satisfaction inside You. Shape my desires until dem match Your will. Make my longing draw me closer to You every day. In Jesus name, amen.
https://open.spotify.com/episode/4o6slKBR42P2shliqKur5F?si=8-_Tv7a8QaCr0yhmX6_kfA
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to continue sharing the gospel and changing lives.
You can support this ministry in two simple ways:
✅ Share this message on your platforms and
with your contacts to help spread the word.
✅ Sow a seed to help us carry on the work of
the ministry and reach more people for Christ.
Follow the Fresh Manna
channel on Telegram: https://t.me/freshmdevo
Follow the Fresh Manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
FRESH MANNA/blogger.com
Email:
teewomenoflight@outlook.com
Your partnership makes a
difference! Together, we can impact lives for God’s kingdom. We truly
appreciate your generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays
Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number:
53178420
PayPal:
prodbyjayt1@gmail.com
Shalom
Comments
Post a Comment