PIDGIN RIGHTLY POSITIONED!
2 Samuel 11
Before dry sizin, for di
time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipol
sojas and dem defeat Ammon pipol kon take-ova Rabbah town. But David stay for
Jerusalem.
2One day, David wake-up from
sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one
woman wey dey baf for en house and e fine well-well. 3So e send messenja go
find out who di woman bi. Leta, dem kon tell am sey na Batsheba, wey bi Eliam
pikin and na Uriaya wey bi Hit pesin, bi en husband. 4David send messenjas go
koll am. Dem koll di woman kom and David sleep with am. Dat time, di woman just
mestrate finish, so e kon go en house back. 5Afta, di woman kon si sey e get
belle, den e send message go tell David.
6David send message go give
Joab, “Make yu send Uriaya wey bi Hit pesin kom meet mi.” So Joab send am go
meet David. 7Wen Uriaya kom, David ask weda evritin dey well with Joab and di
rest pipol and how di fight dey go. 8Den e tell Uriaya, “Make yu go house go
rest small.” Uriaya go en house, den David send gift go gi-am. 9But Uriaya nor
go house, instead e sleep for di palis gate with di guards.
10Wen David hear sey Uriaya
nor go house, e kon ask am, “Yu just kom back from where yu go since, why yu
nor go house?”
11Uriaya ansa, “Israel and
Judah men with di Kovenant Box dey war; Joab wey bi my kommander and en ofisas,
kamp for open place. How I go take go house go chop, drink and sleep with my
wife? So, I use evritin wey dey holy take swear sey I nor go fit do dat kind
tin.”
12So David ansa, “Make yu
stay here today and tumoro, den I go send yu go back.” So Uriaya stay for
Jerusalem dat day and di next day. 13David invite am kom chop and drink till
evening. But Uriaya nor still go house dat nite, instead e sleep for en blanket
for di palis guard-room.
14Di next day, David rite
leta give Uriaya sey make e give Joab. 15Wetin dey di leta na, “Put Uriaya for
di front line, where di fight for strong well-well, so dat dem go kill-am.”
16So, as Joab dey surround
di town, e kon send Uriaya go di place where enemies for strong well-well. 17Di
enemy sojas kom fight Joab sojas and dem kill Uriaya with some of David ofisas.
18Den Joab send messenja go
tell David how di war dey go 19and e tell di messenja sey, “Afta yu don tell di
king about di war, 20e fit vex ask yu, ‘Why una go near di town go fight dem?
Una nor know sey dem go shot arrow from di walls? 21Una don forget how dem take
kill Abimelek wey bi Gideon pikin? Na for Tebez, one woman trow stone from di
wall kon kill-am. Why una go near di wall like dat?’ If di king ask yu dis
tins, den make yu tell am sey, ‘Uriaya wey bi yor offisa, don die too.’ ”
22So di messenja go meet
David kon tell am wetin Joab tok. 23E sey, “Awa enemy strong pass us and dem
from di town kom fight us for open field, but wi drive dem go di town gate
back. 24Den dem shot arrow from di wall kon kill Uriaya and some of yor ofisas.”
25David tell di messenja,
“Tell Joab make e nor fear or vex, bikos dem nor dey know who go die for war.
Tell am make e attack di town well-well kon win am.”
26Wen Batsheba hear sey dem
don kill en husband, e mourn for am. 27Wen e mourn finish, David kon bring am
kom di palis and e born boy for am. But God nor like wetin David do.
No be small thing o! I dey
always talk say Bible na correct library wey carry better collection of books –
e get story of murder, adultery, war, marriage, pikin, betrayal, political
wahala and many more. Bible get plenty genre inside am. One of dem na the
popular story of David and Bathsheba, Uriah wife — we all sabi the gist well
well.
Temptation fit show face for
anywhere and anyhow. Sometimes e go meet person when e even dey for the right
place. But imagine as e go bad reach if person fall for temptation because e no
dey where e suppose dey. How many times we don miss our rightful position wey
God place us?
To dey for correct position
mean say person dey that spot wey God assign give am — im site, im station, or
im condition. We dey always pray make we dey the right place at the right time,
and that one good. But we suppose also pray make we no go land for the wrong
place at the wrong time, and even the wrong place at the right time. David dey
for him palace, na him house be that, but that season he suppose dey for
battlefield, no be rooftop. Because e miss im duty post, temptation catch am,
and e fall for im flesh desire (Galatians 5:16).
Temptation na normal part of
life, but to fall for temptation na sin, because every sin start from
temptation (James 1:15). And when person don enter sin, another sin go follow
(1 John 3:4). Sin dey sweet small, but e dey carry heavy consequence (Genesis
3:1‑19). Anytime we no dey where
we suppose dey, we go end up dey do wetin no correct.
Right positioning matter for
every area of life. E no get limit to the level of sin person fit enter once e
shift from where God put am or e waka comot from God side. We all wan dey
rightly positioned for life, marriage, work, and business. Sometimes people dey
do everything — even wrong things — just to get position wey dem think say na
correct one for dem.
But 2 Samuel 11:1 talk say “David
remain for Jerusalem.” This “but” na big contrast. Na the season when kings dey
go war with their soldiers, but David decide to stay back for palace — out of
him rightful place of duty. That wrong position na wetin open door for
temptation, idleness, sin, cover-up, and finally tragedy.
David send him men go fight
but he himself stay behind. Why? We no know completely. But Ephesians 2:6
remind us say our proper position no be physical one — e dey "in Christ
Jesus." We get this position because of God grace through the blood covenant
— the New Covenant wey Jesus make with Him own blood. That covenant bring
divine exchange — He take our place make we fit take His place.
To enjoy wetin Bible talk
say we be and wetin we fit experience as believers, we gats understand
difference between our position in Christ and our experience for this world. Na
this understanding dey bring spiritual growth and power to live like Jesus talk
say we fit live — with miracle, grace, and strength to overcome temptation when
e show.
We all suppose remain inside
Christ. Colossians 2:12 and Romans 6:4‑7
talk say we don die once with Christ. So we must die to world matter if we wan
stay rightly positioned —
both for life and for Christ.
REFLECTION QUESTIONS
·
Where I dey now for life — spiritually,
emotionally, and physically — na where God want make I dey?
·
Which area of my life I don neglect my
responsibility give God, wey don open door for temptation or distraction?
·
I get relationship, environment, or activity
wey dey drag me comot from my right position for God? Wetin I fit do to avoid
dem?
PRAYER: Papa God, make I no
take my position for You for granted. Make I no ignore the place wey You
position me for another thing. Help me make I always choose the right position
every time, in Jesus name. Amen.
https://open.spotify.com/episode/28JDy8Co9vSvYEzIFwoSDA?si=PYB6kPhKSzey0gu1PkeMwg
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to continue sharing the gospel and changing lives.
You can support this ministry in two simple ways:
✅ Share this message on your platforms and
with your contacts to help spread the word.
✅ Sow a seed to help us carry on the work of
the ministry and reach more people for Christ.
Follow the Fresh Manna
channel on Telegram: https://t.me/freshmdevo
Follow the Fresh Manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
FRESH MANNA/blogger.com
Email:
teewomenoflight@outlook.com
Your partnership makes a
difference! Together, we can impact lives for God’s kingdom. We truly
appreciate your generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays
Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number:
53178420
PayPal:
prodbyjayt1@gmail.com
Shalom
Comments
Post a Comment