PIDGIN QUALIFIED BY GRACE, NOT BY STRENGTH!
1 Korintians 1:25–31 “ Bikos God foolishness wise pass all di sense wey human being get and God weakness strong pass all di pawa wey dem get.
26My brodas and sistas, make
una remember how God koll una, nor bi bikos una wise, strong or get money
well-well. 27But God choose wetin di world tink sey dey foolish and weak, so
dat wise and strong pipol go shame. 28Wetin di world tink sey nor good, naim
God choose; tins wey dem tink sey nor mean anytin, na doz tins E make
important. 29God do like dis, so dat nobody go fit boast for en front. 30Una
don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness
and holiness wey kom from God; 31bikos, God word sey, “Anybody wey won boast,
make e use Christ take boast.”
God no dey call only people
wey already qualify – na Him dey qualify the people wey Him call. Him wisdom
pass human understanding, and Him power dey perfect for our weakness. “The
foolishness of God dey wiser than men, and the weakness of God dey stronger
than men.”
Before we use talk like “I
too young, I too old, I too weak, I no go school reach, I too ordinary” take
disqualify ourselves, God dey call us make we look Scripture and see how Him
dey purposely use wetin world dey call weak to show Him glory.
Examples of “weak” people
and things wey God use:
A left‑handed man — Ehud for Judges 3:15.
An ox goad — Shamgar
ordinary farm tool turn weapon for Judges 3:31.
A woman — Deborah,
prophetess and judge for Judges 4:4–9.
A tent peg — Jael use
ordinary peg for deliverance for Judges 4:21.
A donkey — God open donkey
mouth make e talk for Numbers 22:28–31.
A fish — Bring out coin to
pay tax for Matthew 17:27.
A stone — David use am
strike Goliath for 1 Samuel 17:49.
The jawbone of a donkey —
Samson use am as uncommon weapon for Judges 15:16.
A song and confusion —
Gideon win battle through worship and obedience for Judges 7:19–22.
All this example remind us
say God no need human strength, packaging, certificate or perfection to carry
out Him purpose. Na the Holy Spirit dey enable us.
Many times we dey think say
because we get gift, training or experience, na that one give us right to serve
God. But Bible teach say our sufficiency come from Him: “I fit do all things
through Christ wey strengthens me” say Philippians 4:13. “Not by might or by
power, but by My Spirit, says the Lord” talk Zechariah 4:6, and “Our adequacy come
from God” talk 2 Corinthians 3:5.
God dey chose by purpose, no
be by performance!
God no dey choose based on
age, status, tribe, gender or background. E choose according to Him will and
purpose: John 15:16 talk say “You no choose Me, but I chose you.” Romans 8:29 say
“Those wey He foreknew He predestined to conform to the image of Him Son.” And
1 Samuel 16:7 say, “Man looks outside appearance, but God dey look the
heart.”
We no fit work for or earn
God grace – na free Him dey call, equip and empower us. But na the humble Him
dey lift. The Lord dey use and promote people wey surrender to Am according to
1 Peter 5:6 and Isaiah 64:8.
God dey happy to turn weak
vessels to instrument of power for Him glory.
You go surrender?
Every weak person or thing
wey God use get one thing in common – dem yield to Am. Fish, donkey, stone, peg
– none of dem carry pride or argue with God. God fit use dem because dem dey
available.
How much more wetin Him fit
do with believer wey ready? “Him strength dey perfect for our weakness,” talk 2
Corinthians 12:9. “God don chose the foolish things… so that no flesh go glory for
Him presence,” talk 1 Corinthians 1:27–29.
Believers fit look foolish
for world eye, but for God eye, na treasure dem be. Him dey turn ordinary
people to extraordinary instrument.
God dey find availability,
no be ability – willingness, no be perfection.
Begin from where you dey,
with wetin you get.
He go carry you go where Him
want make you reach.
REFLECTION QUESTIONS
· In
which area of your life you don dey disqualify yourself, and wetin God fit dey
ask you make you surrender give am?
· Which
Bible example of “weak thing” touch you pass, and why?
· How
you fit depend more on the power of the Holy Spirit instead of your own
strength or qualification?
PRAYER: Father, I thank You
say na Your grace qualify me, no be my human strength. Take my weaknesses and
use dem for Your glory. Mould me into vessel of honour – willing, surrendered
and yielded to Your Spirit. Empower me to waka boldly inside the calling wey
You put for my life. In Jesus’ name, Amen.
https://open.spotify.com/episode/1FVBoecjtX8MiSyfRn3UNh?si=oEX_hVqrQEWu-aALj0tj8g
We invite you to prayerfully
consider partnering with us to keep sharing the gospel and touching lives.
you can support this
ministry in two simple ways:
✅ share this message on your platforms and
with your contacts to spread the word.
✅ sow a seed to help us continue the work of
the ministry and reach more people for Christ.
follow the fresh manna
channel on telegram: https://t.me/freshmdevo
follow the fresh manna
channel on WhatsApp: https://whatsapp.com/channel/0029va8y5tqajpxp6kzdox1j
FRESH MANNA/blogger.com
email:
teewomenoflight@outlook.com
your partnership makes a
difference! together, we can impact lives for god’s kingdom.
we appreciate your
generosity and support.
💳 Bank Details for Contributions
Bank Name: Barclays Bank
Account Name: B. Okoh
Sort Code: 20-10-71
Account Number: 53178420
PayPal account:
prodbyjayt1@gmail.com.
shalom
Comments
Post a Comment